Showing posts with label Incest. Show all posts
Showing posts with label Incest. Show all posts

Friday, 1 January 2016

Here Comes The Bride (3)

Nollywood actor, Foluke Daramola, campaigns against domestic violence.
Image: Kokolife

Iniabasi look her husband wit corner eye as he dey sleep. Ukeme just dey roll up and dan like say spirit dey purshoo am. She don bone tire! Why dis her mumu husband dey snore like olden days Volkswagen? Ha ahn! One day, she go fit carry pillow press press im head make he for quiet! Ah ahn!

As if Ukeme know wetin she dey tink, he turn im nyash face her come release one kine mess wey smell pass egg wey done rotten. De mess go straight go her face like say na wetin in bin dey target.