![]() |
| Nollywood actor, Foluke Daramola, campaigns against domestic violence. Image: Kokolife |
Iniabasi
look her husband wit corner eye as he dey sleep. Ukeme just dey roll up and dan
like say spirit dey purshoo am. She don bone tire! Why dis her mumu husband dey
snore like olden days Volkswagen? Ha ahn! One day, she go fit carry pillow
press press im head make he for quiet! Ah ahn!
As if
Ukeme know wetin she dey tink, he turn im nyash face her come release one kine
mess wey smell pass egg wey done rotten. De mess go straight go her face like
say na wetin in bin dey target.
